Di Central Bank of Nigeria (CBN) don lift foreign exchange ban wey dem place on 43 items.
Wetin dis one mean be say importers of dis items fit get access to foreign exchange from di Nigerian foreign exchange market as di apex bank don lift di ban.
You go remember say for 2015, CBN bin restrict di importers of di items from accessing foreign exchange from di I&E window as dem tok say di items no dey valid for foreign exchange as na sometin wey dem fit produce for Nigeria.
Some of di items wey dey affected dat time include rice, cement, vegetable oils, margarine, amongst oda tins.
Di apex bank make di announcement for one press release on Thursday wey dia director of corporate communications sign.
For di press release, CBN tok say dem go ensure say dem boost liquidity for di Nigerian foreign exchange market as dem go intervene from time to time.
According to di CBN, as market liquidity improve, dia intervention go gradually decrease.
Di apex bank for di press release tok say dem go continue to promote orderliness and professional conduct by all participants for di Nigerian foreign exchange market to ensure say forces determine exchange rat on a willing buyer-willing seller principle.
“Di CBN dey committed to accelerate efforts to clear di FX backlog wit existing participants and go continue dialogue wit stakeholder to address di issue.
“Di CBN don set di attainment of a single FX market as one of dia goals. Consultations dey go on wit market participants to achieve dis goal,” di apex bank tok.
Full list of di items wey CBN lift foreign exchange ban ontop
Rice, cement, vegetable oils, palm kernel, palm oil products, margarine, meat and processed meat products, vegetables and processed vegetable products, poultry and processed poultry products, tinned fish in sauce (geisha)/sardine, cold rolled steel sheets, galvanized steel sheets, roofing sheets, wheelbarrows and head pans.
Odas na metal boxes and containers, enamelware, steel drums, steel pipes, wire rods (deformed and not deformed), iron rods, reinforcing bars, wire mesh, steel nails, security and razor fencing and poles, wood particle boards and panels, wood fiberboards and panels, plywood boards and panels, wooden doors, toothpicks as well as.
Di oda items na glass and glassware, kitchen utensils, tableware, tiles-vitrified and ceramic, gas cylinders, woven fabrics, clothes, plastic and rubber products, polypropylene granules, cellophane wrappers and bags, soap and cosmetics, tomatoes/tomato pastes and eurobond/foreign currency bond/ share purchases